published on in Celeb Gist

Fredie Blom: 'World's oldest man' die at 116 year for South Africa

23 August 2020

One South Africa man wey fit be di oldest man for di world don die at di age of 116 years.

Fredie Blom identity document show say dem born for Eastern Cape province for May 1904, although Guinness Book of Records no eva verify am.

Di 1918 Spanish flu bin kill im whole family wen im be young boy. Im later survive two world wars plus apartheid.

Oga Blom bin tell BBC for 2018 say im no get any special secret for im long life.

"Na only one tin - di man above [God]. Im get all di power. I no get anytin. I fit drop anytime but Im hold me," he tok.

Oga Blom spend most of im life as labourer - first for farm and later for construction industry - im only retire for im 80s.

Although im stop to dey drink many many years ago, im na regular smoker.

But, sake of di coronavirus lockdown wey South Africa goment impose, tori be say im bin no fit see tobacco buy to roll im own cigarette on im 116 birthday.

Oga Blom family say im die of natural cause for Cape Town on Saturday.

"Two weeks ago oupa [grandpapa] bin still dey cut firewood," tok tok pesin for di family Andre Naidoo tell tori pipo AFP news agency. "Im bin be strong man, full of pride."

But wetin few days im shrink "from big man to small pesin," im add.

Oga Naidoo say im family no believe say im death get any connection wit coronavirus.

ncG1vNJzZmivp6x7o67CZ5qopV%2BltqWzyKdmbmtobIZzg5c%3D